You are implored to
join the NaijaLyrics Club as there are so many opportunities you get by joining. It will do us more good, if you also tell a friend about this site. That won't take your time, I think.
Tell a friend Now.
"Naija must sweet again" by Lagbaja
Song Title: Naija must sweet again
Artiste: Lagbaja
From Album:
Year : 0000
Genre :
Lyrics:
Nigeria na one country, yes
The thing God done put together, let no man put asunder
But sha if we no go scatter am we must balance am well well
Everybody must happy
Some no go dey belle full make others dey hungry, Haba
One day hungry man go angry o
Leadership, government, president no be personal property
Power no be birthright
Equal rights and justice na him go bring unity and progress
Solution to make Nigeria better, E dey here for Naija
If we find better leader Nigeria go better o
Correct brain with correct solution he boku for Naija
Haba, sebi na chop chop na him close sense
Oyinbo wey him organise, se him get two head
Hisshh, Naija it done swet before before o,
It must sweet again gan
Country hard, country hard (horns)
Na him I pack my load, I check out
Baa ba nrelu oyinbo ka mohun a nwa lo (horns)
En I dey o I dey go I dey go ilu oyinbo
Se iyawo wey he never taste two husband house
He no go know which one sweet pass (horns)
Because of pounds and dollars I face yankee
My visa expire still mo nfa gburu (horns)
Otutu pa sege olopa o de gbodo gan mi
Emi omo onile olona mo wa di gbaatu eyo (horns)
If I greet oyinbo for road he go point him nose for sky
Emi omo afojapon omo onile olona, big man for my area
Wolukilumo, Eni ko o mo eni mo o ko
Iya mi o gbodo gboya to nje mi aya nbe nile omo nsuffer
Haa, kese, mo ranti ile mo forin aro bonu
Oh my home oh my home, When shall I see my home
When shall I see my native land, I will never forget my home
After my eye clear I pack my luggage ile ya
Ko baje funlu oyinbo enough is enough
Before I get visa nko I know how I suffer
Mo tun wa debi tan perambulation (horns)
O yes I made some bread man, but home na home now (slam horns)
If them tell you say yonder dey sweet gan, is a lie
Many of my people yonder na suffer head (horns)
Oyinbo self nko, illiterate boku, some cannot read, some cannot write
Ignoramus asoyinbo naa le tabon (horns)
Me wey I think every oyinbo get money haa
Posted by: